Na 2022 be this so. Na soso figure 8 people dey find upandan. Correct food combo don dey ground wey go help with Weightloss
Like dis eh e no need make pesin say e no wan chop again o because e no good for body if owner of body no chop food. E just be like Moto. If pesin no buy fuel put inside Moto, Moto no fit move o naso body sef be.
Na Lai dai some people dey think say Dem no chop dey go remove fat for body, dat one na big lie o pesin wey no chop we dey fast everyday sef still fi carry weight pas pesin wey dey chop steady. Naso lyf be.
Na hia be junction wey go dey tok about wetin pesin wey wan remove yamayama for body fi chop for whole day wey e no go dey feel weak Abi e go dey feel hungry.
Morning
Fried egg + 2 Slices wheat bread + Green Tea / water
Afternoon
Vegetable sauce + wheat
Night
Spaghetti + chicken sauce
Snacks
Apple, pop corn
Na confam na em wey don drop laidis o. If e wan see confam result make e dey chop am small small no be big bowl o, come sidown watch as e go take balance
Comments
Post a Comment